Why dis couples wey marry for mass ceremony no fit dance for dia own wedding

One mass wedding wey involve 50 couples don occur for Afghanistan.

Dis kain wedding don dey common among poor couples wey dey try reduce di high costs of traditional wedding.

Di brides-to-be bin dey one corner wia nobody fit see dem – na only afta lunch dem show, local tori pipo say.

Na one charity organisation bin organise di occasion wey happun for Kabul.

Dem also provide di new couples wit some property like one carpet plus electronics to take start dia married life.

One official from di Ministry for di Promotion of Virtue and Prevention of Vice, speak for di low-key ceremony.

As part of di occasion dem recite Koran, but dancing and music still dey banned by di kontri Taliban leaders since dem come back to power for August 2021.

Dem carry di brides and groom for cars wey dem decorate wit green ribbons and red plastic roses wey dem shape like hearts.

Roohullah Rezayi, 18, explain give tori pipo AFP say im bin no fit afford solo wedding.

“One traditional wedding for cost us at least 200,000 to 250,000 Afghanis [£2,220 to £2,770; $2,800 to $3,600] but dis time na between 10,000 and 15,000 Afghanis,” im tok.

Di young man, wey be member of Hazara Shia Muslim minority and from Ghor province, dey collect 350 Afghanis per day doing odd jobs, di agency tok.

“We bin invite 35 pipo from our two families, otherwise e for be 300 to 400,” im add.

For some of di grooms-to-be, dem don over wait, AFP add.

“I don dey wait for dis day for three years,” Samiullah Zamani, one 23 years old farmer from Kabul province tok. “I no fit wait to see her.”