‘Di Catholic Church no dey change dia mind on blessing same sex marriage’

Di Archbishop Emeritus of Abuja for Nigeria say one document wey Pope Francis approve regarding blessing of same sex couples don dey misinterpreted.

Di document wey di Vatican release on Monday allow priests to bless same-sex and “irregular” couples, under certain circumstances.

Di announcement bin dey seen as a historic shift for d position of di Catholic Church regarding same sex unions. However, inside interview with BBC, Cardinal John Onaiyekan say despite pressure to conform, di position of di Catholic Church never change, and dem no go bless same sex marriage.

For one document wey di pope approve and issue on 18 December, di Vatican bin declare say priests dey permitted to bless same-sex and “irregular” couples under certain circumstances.

However, di text tok say dat kain blessing no go be part of regular Church rituals.

Di text bin spark reactions and interpretations say maybe di church fit don dey shift ground, but Cardinal Onaiyekan say na mata of doctrine and di church no dey about to change.